BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Ex-gang boss dey guilty of di murder of rapper Tupac Shakur - Jury
Duane "Keffe D" Davis conviction end decades of mystery as to who dey behind di rapper death.
Tinubu confam release of 15 kidnapped NYSC victims, six odas for Kogi
President Bola Tinubu ontop X on Monday tok say di Search and Rescue (SAR) team rescue all di 21 abductees, (13 female men and 8 males) from di kidnappers den in di forest of Ofu LGAs for Kogi State on Monday afternoon.
Wetin we know as former Nigeria minister Timipre Sylva resign from APC
Timipre Sylva wey be former Bayelsa State govnor dey face plenti gbege for Nigeria under president Bola Tinubu administration.
Tinubu report xenophobic attacks for South Africa to African Union, say make dem take action
Di president wey dey represented by Vice President Kashim Shettima for di 21st Extraordinary Session of di Assembly of di African Union for Luanda, Angola, say di incidents for South Africa undermine Africa solidarity, unity and peaceful coexistence.
Death toll from Nepal heavy flash floods rise to 903 as 4,247 pipo still dey miss
Di army tok-tok pesin say dem don rescue 50 foreign nationals, including 30 Indians, eight Chinese, eight Koreans, two Americans and two Italians. South Africa foreign ministry don confam say six of dia citizens dey among pipo wey miss afta di heavy flood wey happun for Nepal.
'Tinubu get right to challenge release of alleged drug trafficking record' - Lawyer
Carmichael say President Tinubu bin act based on legal advise wen e move to stop US govment agencies from releasing alleged records and documents wey get connection to allegations of drug trafficking.
Burkina Faso and Mali react to mutiny attack for Niger
Niger say dem don regain control of one key military airbase for di capital, Niamey, afta revolutionary soldiers attack di site plus oda strategic locations.
Jamb give candidates deadline on admission offer
Di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don extend di deadline for candidates wey dem offer admission to either accept or reject am on or bifor Wednesday, 30 September.
'Within one year we go control insurgency and insecurity for Nigeria' - Atiku Abubakar
Di veteran politician wey don always tok say e go remove fuel subsidy also tok say im dey healthy, agile and younger dan di current president of Nigeria - so im fit lead Nigerians well.
Special Tori
Satellite images of wetin Nepal look like bifor and afta as number of missing pipo rise to 4,247
Bifor and afta images show villages, bridges and one important Nepal-Tibet border crossing wey ogbonge floodwater wash away.
'I first realise say I no get fingerprints wen I bin go register for Jamb' - why some pipo no dey get fingerprints
Hauwa Jidda Suleiman na one of di pipo wey dem born witout fingerprint, one rare condition wey dem dey call adermatoglyphia.
Nigerians dey face accuse of sextortion for US - Wetin be sextortion and possible jail term for offenders
Two Nigerians don land America to face prosecution on top accuse say dem dey involved in online sextortion schemes wey link to di death of one American teenager
'Register your marriage' - Why South Africa Home Affairs give couples deadline to register marital status
South Africa Home Affairs say many couples don fail to register dia customary marriages even though dem sabi say di law dey effective.
King Harald of Norway don die at di age of 89
Di late king rule for 35 years and e break tradition as e marry commoner but e dey widely loved by Norwegians.
Nigeria kidnappers collect nearly $6 million as ransom for 2025 - Report tok
Di report tok say Boko Haram collect 90% of di entire ₦7.779 billion wey kidnapper collect as ransom, from just two mass abduction of ova 700 pipo, wey happun for Niger state and Borno in 2025.
67 Nigerians return from South Africa ahead of September 30 deadline for all illegal immigrants to comot
Di March and March group for South Africa dey maintain pressure for dia anti-immigration protests wit di new deadline of 30 September approaching.
How two airport workers die of malaria afta 'mosquito enta inside plane'
German public health officials believe say di outbreak na sake of mosquitoes wey enta plane take flight to di busiest airport for Germany.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.















































